obodo oyinbo

580 Results / Page 22 of 65

Background

obodo oyinbo

China Missile Test Shake Pacific, Australia

By: Yusuf Abuh Japan, New Zealand like dis now dey call world pipo make dem hold china oh, dat china dey test bomb for Pacific Ocean. Chinese gornment talk say di test na part of dia yearly military training and e no target any country. Japan, Australia and New Zealand don raise concern, which one be, e nor target anybody, na play, play dey turn to hit and go, dat […]

todayJuly 6, 2026 18

obodo oyinbo

Iran Rake Say US And Israel Na By-Force Dem Take Recognize Iran Regional Power

By: Yusuf Abuh Iran parliament tuk, tuk, Mohammad Ghalibaf, don drop a bumbshell say United States and Israel nor get level naim make dem sign agreement to work together. Ghalibaf yan dis word for meeting with Yemen Vice Presido, Mohammed Al-Nuaimi, as e dey praising dis e achievement, say no level. E follow talk say di agreement na big political and military failure for America, but na massive win for […]

todayJuly 6, 2026 25

obodo oyinbo

Iran Warn US & Israel As 20 Million Pipo Gather For Khamenei Burial

Iran top negotiator don sama warning say, if US and Israel refuse to end di war as dem promise, Iran go change am for dem. Dis warning dey come as over 20 million pipo gada  for Tehran for di burial of former Supreme Leader Ali Khamenei, wey kpai follow im family members since di war start. Iran army commander self done swear say dem must revenge di blood of Ayatollah […]

todayJuly 3, 2026 22

obodo oyinbo

WHO Clear Cruise Ship From Deadly Disease, Hantavirus

Di World Health Organization (WHO) on Thursday declare say di deadly hantavirus outbreak inside di cruise ship MV Hondius don officially end after di last person leave quarantine. Inside press conference, WHO Oga Tedros Adhanom Ghebreyesus naim announce di ogbonge update. U sabi say, na 12 pipo catch di virus and three kpai since di ship comot Argentina on April 1. And dis mata bin shake everywia for dat April […]

todayJuly 3, 2026 18

obodo oyinbo

Gaza Mark 1,000 Days Of War Wahala As Over 73,000 Pipo Kpai

Gaza officials don announce say di war don clock 1,000 days, as over 90 percent of di territory don suffer serious damage from di fighting. Di Gaza Gornment Media Office talk on Thursday say Israeli forces now control about 80 percent of Gaza land. According to di latest figures from Gaza, at least 73,066 Palestinians don die since di war begin for October 2023. As di war continue, international organizations […]

todayJuly 2, 2026 17

obodo oyinbo

13 Pipo Kpai, 86 Wunjure As Russia Use Missile and Drone Scatter Kyiv

According to Kyiv Mayor, Vitali Klitschko, at least 13 pipo don kpai, while 86 pipo carry wunjury after Russia missile and drone attack tear plenti houses inside Kyiv for early momo Thursday. Di attack happen just few hours after Ukraine Presido, Volodymyr Zelensky, warn say Russia dey prepare one massive attack. Media tuk tuk pesin wey dey for central and eastern Kyiv tuk say dem hear more than 12 loud […]

todayJuly 2, 2026 20

obodo oyinbo

Portugal Enter Emergency Mode As Heatwave Worsen

Portugal weather agency, wey dem dey call IPMA, don put  Lisbon and Setubal regions for red alert on Thursday because of dangerous heatwave wey dey spread across di kontri, while Leiria and Coimbra go join di alert on Friday. IPMA tok say temperature fit reach 44 degrees Celsius for some northern areas, while Evora and three oda inland regions don already enter orange alert on Wednesday as Europe dey battle […]

todayJuly 2, 2026 18

obodo oyinbo

Cholera Kpai 120 pipo for Sudan

By : Jolayemi Olajide Nor be small tin say one wicked  cholera outbreak don scarra  Sudan,   kpai  120 pipo, and dem sti dey suspect  1,102  cases. The World Health Organization (WHO) tuk say di three years war between the Sudan army and the RSF fighter group don scatter the country healthcare system kpata-kpata. Dis na di third time wey cholera heavy wave dey hit Sudan back-to-back inside three years, just […]

todayJuly 1, 2026 18

obodo oyinbo

Heatwave Kill Over 1,000 People For Spain

More than 1,000 pipo don kpai for Spain because of di recent heatwave wey roast Europe. Spain Carlos III Health Institute konfam dat at least 1,028 pipo naim don kpai from heat-related sickness during di extreme hot weather. Di death figure double di 407 deaths wey Spain record for June 2025, wey bin be di hottest June before. Weather agency Aemet also confirm say di first six months of 2026 […]

todayJuly 1, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds