obodo oyinbo

429 Results / Page 22 of 48

Background

obodo oyinbo

California Teacher Na Suspect For Trump Gala Shooting

Dem don expose di suspect wey fire bullet for White House Correspondents’ Association Dinner wey US Presido, Donald Trump and oda big oga dem attend, according to CNN. Di suspect, Cole Tomas Allen, 31-year-old na teacher and video game developer from Southern California, wey dey live for Torrance, suburb for Los Angeles. Authorities talk say dem quickly gbab Cole with plenti weapons for body, after e use force pass security […]

todayApril 26, 2026 17

obodo oyinbo

Germany Plan To Send Minesweeper Go Hormuz

Germany go soon send one minesweeper ship go Mediterranean Sea for possible mission for Strait of Hormuz after US and Iran war don end, defence ministry spokeswoman tell AFP on Saturday. Some countries don talk say dem ready join “neutral” mission to secure Strait of Hormuz. US talk last week say dem dey clear sea mines with Iran, but Iran never confirm am. German navy ship “Fulda” go deploy “within […]

todayApril 25, 2026 14

obodo oyinbo

Gulf War Fit Trigger Food Insecurity Surge – IMF

International Monetary Fund don drop warning say food wahala fit scatter well-well for Nigeria and other African countries as Gulf War disruption dey shake economy, dey threaten di small recovery wey di region just dey try hold. Dem talk dis one as 2026 Global Report on Food Crises show say war, drought, plus reduction in aid go keep hunger level for world high, especially for countries wey already dey weak […]

todayApril 25, 2026 20

obodo oyinbo

Palestinians Line Up Vote for First Election Since Gaza War

Palestinians for West Bank and one central part of Gaza don start to vote on Saturday for municipal elections. Dis na di first voting since Gaza war, as political options tight and many people no too get hope. About 1.5 million people register to vote for Israeli-occupied West Bank, plus 70,000 people for Deir el-Balah area for Gaza, according to Central Elections Commission wey dey Ramallah. Video from Al-Bireh for […]

todayApril 25, 2026 14

obodo oyinbo

Trump Extend Israel-Lebanon Ceasefire

By: Esther Ayoola U.S presido, Donald Trump don announce, say Israel and Lebanon ceasefire go continue for another three weeks afta dem hold tuks for White House. According to trump, for di peace deal to last, e go sti need plenty support from Washington especially to help disarm Hezbollah. Trump con sti go yarn for BBC say, everything wey im dey do, dey show positive result. When tori pipo ask […]

todayApril 24, 2026 17

obodo oyinbo

US Accuse China Group Of Trying To Steal American AI Tech

White House science and tech boss, Michael Kratsios don accuse China-linked groups, say dem dey try steal American AI technology. Dem accuse dem say na through “distillation” and other hacking-style methods dem take dey copy powerful AI systems wey companies like OpenAI and Anthropic build, to catch up with US innovation. Dis accusation dey come as tension sti dey rise between US and China ahead of planned leaders’ meeting for […]

todayApril 24, 2026 19

obodo oyinbo

Iran Tankers Still Dey Pass US Blockade For Hormuz

According to Financial Times report on Wednesday, at least 34 tanker ships wey get link to Iran still dey waka pass Strait of Hormuz for recent days, even though US dey block di Strait. But US Presido, Donald Trump sti talk say America “fully control” di Strait of Hormuz, and claim say di blockade strategy dey work well well. On April 13, US put blockade wey dem talk say go […]

todayApril 23, 2026 22

obodo oyinbo

I No Go Resign – Keir Starmer

British Prime Minister Keir Starmer don talk say e no go resign, despite say people dey accuse am say e mislead MPs about how e take appoint Peter Mandelson as UK envoy for Washington. E tuk for parliament say di mata don turn pass tense so no need to raise durst for di mata. According to report dis mata don cause serious pressure for am, especially as pipo dey call […]

todayApril 23, 2026 12

obodo oyinbo

Kyiv Jaguda Boy Shooting Bring Serious Argument For Ukraine

By: Esther Ayoola For Kyiv, Ukraine, gunman don go shoot and kpai seven pipo near supermarket, and di attack don spark serious debate about who suppose carry gun for di country. Authorities say di shooter, wey mama dem born for Moscow and later live for eastern Ukraine, use registered weapon do di attack but im motive sti no clear. Ukrainian lawmakers dey now argue say, pipo need more right to […]

todayApril 22, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds