obodo oyinbo

429 Results / Page 24 of 48

Background

obodo oyinbo

US Navy Seize Iranian Ship For Gulf, Iran Vow To Retaliate

By: Esther Ayoola US Presido and Im Navy don go intercept one Iranian cargo ship wey dem dey call Touska for Gulf, as part of dia blockade dey cause serious gbege. Trump explain for im Truth Social say di ship no respond when dem warn am make e stop, naim make dem seize am. Iran dey vex for di other side, say na violation of ceasefire and dem go retaliate, […]

todayApril 20, 2026 14

obodo oyinbo

Iran insist say Strait of Hormuz Go Remain Open till Ceasefire End

Iran don talk say Strait of Hormuz dey fully open for all commercial ships to pass as ceasefire dey between Israel and Lebanon. Abbas Araghchi yarn this one for X, say as dem agree ceasefire, ships fit move freely for the remaining time. Dem also talk say make vessels follow the normal coordinated route wey Ports and Maritime Organisation of Iran don already announce. Di so called  ceasefire wey dem […]

todayApril 17, 2026 22

obodo oyinbo

UK King To Address US Congress For Visit

Say King Charles III wan give important speech for US Congress later dis month as part of im first state visit to United States. Buckingham Palace naim dey convasate dis one say from April 27 and go last four days, di king go address lawmakers with Queen Camilla by im side. Dem say di visit na to strengthen shared history and strong relationship between both countries, plus people-to-people connection.

todayApril 17, 2026 19

obodo oyinbo

Armed Robbers Strike Naples Bank, Hold 25 Hostage for 2 Hours

Say Three masked armed robbers enter a Credit Agricole bank for Naples, Italy on Thursday rob wetin nor good for dia. According to a police source, dem carry out the robbery for safe deposit boxes. Say di robbers, take about 25 customers and staff hostage inside the bank, as dem force control person  to search for money and valuables. According to Naples Prefect Michele di Bari, di robbers later escape […]

todayApril 17, 2026 15

obodo oyinbo

Lebanon Ceasefire Start officially as US, Iran prepare for Peace Deal

Lebanon dey celebrate today Friday say, US State Department don  announce 10-day ceasefire wey go allow Israel and Lebanon officials sit down negotiate permanent peace and security agreement. Di US Presido, Donald Trump  also tuk say, di deal to end di war with Iran dey very close, and say negotiations fit resume this weekend. Iran Foreign Ministry, according to Iranian state media, don also konfamate di update, welcoming di ceasefire […]

todayApril 17, 2026 11

obodo oyinbo

Iran Military Make Move To Block Red Sea, Gulf Trade After U.S Naval Blockade 

Iran military don sama warning say dem go block trade for Red Sea, Gulf, and Sea of Oman if US naval blockade on Iranian ports continue. Military commander Ali Abdollahi and Iran central command na im tuk dis one for State broadcast. According to di senior men, US dey create cause problem  for Iran ships and oil tanker movement, and dis sef violate dia ceasefire agreement. Military commander Ali make […]

todayApril 16, 2026 26

obodo oyinbo

U.N Oga Guterres Beg US, Iran To Hold Serious Tuks

UN Secretary-General António Guterres like dis dey  call for serious tuk between United States and Iran, say make dem follow international law. E talk dis one to journalists for UN headquarters for New York on Tuesday. Guterres say humanitarian and legal responsibilities dey ignored for di Middle East mata and other places, and dis dey cause serious chaos, suffering and destruction.

todayApril 15, 2026 16 2

obodo oyinbo

Israeli Break Ceasefire Kpai 11 People For Gaza

Israeli military attack for Gaza Strip don kpai at least 11 Palestinians for different parts of di area. According to reports from medics and authorities on wednesady, among di dead na two children, one 3-year-old and one 14-year-old, wey come from di northern side of di conflict zone. For Gaza City, dem sti carry problem go strike police vehicle kpai about four pipo, including one police officer, and wunjure at […]

todayApril 15, 2026 15

obodo oyinbo

Wadagni Win Benin Republic Presidential Election Land Slide  

Provisional results wey come from  Benin Republic presidential election, say  Finance minister Romuald Wadagni don win di election with about 94 percent of votes, According to report, di electoral ogas never give final official result, but Wadagni don already take clear lead. Im opponent Paul Hounkpe don already accept defeat and congratulate am even before dem finish counting all di votes. Wadagni wey be 49 years old get strong support […]

todayApril 14, 2026 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds