obodo oyinbo

580 Results / Page 37 of 65

Background

obodo oyinbo

US Plan To Comot About 5,000 Troops From Germany

US Defense Secretary, Pete Hegseth,  don order make about 5,000 American soldiers comot from Germany within di next one year, according to Di Pentagon on Friday. Dis move dey come as fresh wahala dey show for relationship between United States and Europe over di Middle East war. At di same time, Donald Trump announce say tariff on cars and trucks from di European Union go rise to 25 percent from […]

todayMay 2, 2026 25

obodo oyinbo

Two Men Kpai Senior Magistrate For Bolivia

Top judge for Bolivia, Victor Hugo Claure, don kpai after two men gun am down inside taxi for Santa Cruz. Police talk say di attack happen on Thursday night when two men ride pass on motorcycle, and one of dem begin spray bullets into di taxi wey di judge dey inside. Claure, wey be one of di highest judges for Bolivia agro-environmental court, bleed out before dem fit carry am […]

todayMay 2, 2026 25

obodo oyinbo

Xenophobic Attacks Dey Wor Wor For South Africa

As tension dey rise for South Africa, Nigerian Consulate, together with Nigerian Citizens Association in South Africa, don arrange free repatriation flight for Nigerians wey wan return home permanently. According to President of NICASA, Frank Onyekwelu, e say di wahala don force many Nigerians to lock their shops and businesses. E add say, no serious support system dey on ground for Nigerians wey di crisis affect, but di consulate intervention […]

todayMay 2, 2026 25

obodo oyinbo

Hegseth Face Senate to Explain di Middle East War

US Defence Secretary Pete Hegseth don finish im second day for Senate hearing wey dem dey ask am about US military budget and Iran war. Im go Congress to request $1.5 trillion budget, but lawmakers still dey press am plenty questions about di ongoing Iran war. Meanwhile, US Navy don begin restock dia ships for Middle East with fuel, food, ammunition and other supplies to support operations.

todayMay 1, 2026 24

obodo oyinbo

Germany Make Moves To End Strait Of Hormuz Blockade  

Senior man German Chancellor Friedrich Merz like dis dey cut chain oh, say Germany ready to help stop Iran from blocking Strait of Hormuz. Im yarn dis one During im visit to German army for Munster, e say dem fit even use military join secure free movement of ships if need arise say any long blockade go cause serious economic wahala for many countries. Russia don talk say dem go […]

todayApril 30, 2026 33

obodo oyinbo

Germany Make Moves To End Strait Of Hormuz Blockade

By: Esther Ayoola Senoir man German Chancellor Friedrich Merz like dis dey cut chain oh, say Germany ready to help stop Iran from blocking Strait of Hormuz. Im yarn dis one During im visit to German army for Munster, e say dem fit even use military join secure free movement of ships if need arise. Say any long blockade go cause serious economic wahala for many countries.

todayApril 30, 2026 20

obodo oyinbo

How US Blockade Put Dey Affect For Iran Oil Business

By: Esther Ayoola Iran Parliament Speaker Ghalibaf tuk say US blockade nor be any issue to dem, and say Iran fit still manage di pressure for about 30 days. US dey insist say di blockade dey affect Iran oil trade, and e fit force dem to store oil reach level wey go slow or stop production. According to reports,  Iran oil storage don rise since April 13, especially for Kharg […]

todayApril 30, 2026 31

obodo oyinbo

Israel And Lebanon Clash Worsen As Air Strike Kpai, Kpai Rescue Workers

By: Esther Ayoola Israel military don carry out some wicked air strikes for southern Lebanon, even reach areas wey dem call “Yellow Line”. According to report, One of di strikes kpai five pipo, including three civil defence workers wey dey try rescue pipo from earlier attack, and two Lebanese soldiers sti get wunjury. Lebanon Prime Minister Nawaf Salam don condemn di attack, call am war crime, and say dem go […]

todayApril 29, 2026 28

obodo oyinbo

King Charles Preach Western Unity For US Congress

By: Esther Ayoola Britain king, King Charles III, don go scatta mouth for US Congress, say make America dey careful, even with di wahala for Iran and Ukraine. Say dem nor suppose leave dia Western allies. Di Senior King porporly dis mata for di congress without touching Donald Trump and Keir Starmer gbege, insisting say US and UK partnership strong like di wall of Jerico.

todayApril 29, 2026 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds