south west

105 Results / Page 7 of 12

Background

south west

Jaguda Boys Rascality For Ogun State kpai 6 Pipo

By: Shalom Ovie Six pipo naim don kpai after some kidnappers go scata dredging site for Obafemi-Owode LGA, Ogun State. Dem invade di site early Monday morning as dem try abduct one Chinese national, but di operation fail and violence break out. Ogun State Police Command confirm say one soldier, one local hunter and four other persons die for di attack. By Wednesday, residents for Fowowawo, Ajerogun and Magbon-Etido don […]

todayJune 11, 2026 14

south west

Stage Collapse For Inside Osun State as Adeleke Dey Do Rally

By : Jolayemi Olajide For Inside Osun State, fear gbab everybody on Wednesday, as di stage wey Osun State Govo, Ademola Adeleke and other big men dem dey use for rally burst enter ground for Ijebu Jesa. Dis particular gbege dey for inside 30 seconds video wey tori pipo collobi during di rally. Inside di video, musicians still dey perform for stage when di MC wan announce di next thing […]

todayJune 11, 2026 9

south west

City Boy Movement Oga Olufemi Onireti Do Medical Giveaway Oyo Community

By : Jolayemi Olajide Oga Director for City Boy Movement inside Oyo State, Olufemi Onireti, don distribute ogbonge medical equipment and drugs give Esinele community for Oriire Local Government Area on Tuesday. Onireti wire dis beta donation during one solidarity visit to help di pipo afta bad boys go kidnap some teachers and school pupils inside di area. Di politician speak inside the community say e get hope say dem […]

todayJune 10, 2026 14

south west

Gunmen Kidnap Ifedayo Local Government Vice Chairmo For Osun

By : Jolayemi Olajide Problem dem say e nor dey finish, dad some jaguda boys don sti go kidnap the Vice Chairmo of Ifedayo Local Government Area, Debo Farounbi, attacking Ora community along Osun and Kwara boundary on Tuesday night. Di bad boys storm di area around 10pm, scata bullet for air, cause serious fear before dem bundle the chairmo and three other pipo face bush. According to tatafo pipo, […]

todayJune 10, 2026 14

south west

Osun Police gbab 3 Suspected Cultists, jaguda boys, Recover Pistols

By : Shalom Ovie Osun State Police Command say dem don arrest three suspected cultists and political thugs during separate operations for di state. For statement wey Police Public Relations Officer, DSP Abiodun Ojelabi release on behalf of CP Ibrahim Gotan, dem identify di suspects as Adekola Olayinka Abdulazeez, Omolara Ezekiel and Babatunde Azeez. Police say dem recover dangerous weapons from dem including three English Beretta pistols, cut-to-size gun, live […]

todayJune 10, 2026 11

south west

Ogun Gorment Set Up Committee To Secure Schools

By: Esther Ayoola Ogun State Gornment don decide oh say dem nor wan hear dem shoot bird mama fly, like dis don set up security Committee to tackle jaguda boys for schools. Na oga Commissioner for Education, Prof. Abayomi Arigbabu, naim carry dis mata tuk give tatafo, say di committee go hellep improve safety, emergency response and beta learning environment for students and teachers. Di senior man commissioner explain say […]

todayJune 9, 2026 8

south west

Oyo Police Kpai Two Kidnappers As Dem Rescue Former Power Minister Adelabu Sister

By: Esther Ayoola Oyo State Police Command don kpai two suspected kidnappers inside di sharp operation wey dem do on Saturday night to rescue former Minister of Power sister,  Busayo Adelabu-JohnPaul, and her 12-year-old twin boys. Di Commissioner of Police for di state, Abimbola Olugbenga, naim sunch dis mata for Ibadan on Sunday, unto how dem take recover heavy weapons,  juju wey dei kidnappers dey use. CP Olugbenga explain say […]

todayJune 8, 2026 12 1

south west

Adelabu Family Thank Security Say Dem Rescue Im Sister, Her Twins

By: Esther Ayoola Family of former Minister of Power, Adebayo Adelabu, don tank Naija security agents for dia doings say dem rescue im sister, Olaide Adegoke John-Paul, and her 12-year-old twin pikins wey dem from kidnappers hand. Di former minister mama, Olufunmilayo Adelabu, naim con dey fry mouth give tori pipo, unto how her body dey sweet her thank everybody for di support and prayers during di wahala. As she […]

todayJune 8, 2026 14

south west

FG Vow To Rescue Kidnapped Oyo, Borno Pupils, Say Terrorism No Go Win

By: Esther Ayoola Di Federal Gornment don assure Nigerians say dem dey do everything possible to rescue di 82 pupils and teachers wey kidnappers carry for Oyo and Borno States. Di Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, tuk dis one on Thursday for Radio House, Abuja, during one special national security tuk tuk wey dem do for Abuja According to Idris, baba seyi don direct security agencies to […]

todayJune 5, 2026 18 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds