south west

105 Results / Page 9 of 12

Background

south west

Police Pour 2,500 Men Enter Ojude Oba Festival For Ogun

By: Esther Ayoola Ogun Police don spread more than 2,500 officers for Ijebu Ode and nearby areas ahead of 2026 Ojude Oba festival wey go happen Friday. Police spokesperson, DSP Oluseyi Babaseyi, yarn dis one for statement wey dem release on Thursday. According to am, di officers come from different units like Mobile Police, SWAT, Anti-Kidnapping Squad and Force Intelligence Department. Police say dem put di security arrangement to keep […]

todayMay 28, 2026 14

south west

Army Send Special Forces To Rascal Bad Boys

Di Chief of Defence Staff, General Olufemi Oluyede, don order make dem deploy special forces and plane elements to Oyo State sake of di recent kidnapping wahala. Di Director of Defence Media Operations, Maj. Gen. Michael Onoja, tuk dis one for Abuja on Tuesday as he give update on top di work wetin army do for May. Onoja sti assure residents say soldiers nor go rest at all until dem […]

todayMay 27, 2026 13

south west

Ogun Gornment Face Police Boss, Not To Mix Mouth For Church Land Case

By: Esther Ayoola Ogun State Gornment don warn one big police oga for Force Intelligence Department Abuja, AIG Enyinnaya Adiogu, to stop di double touch lighting wey im dey do on top one land case wey connect one Church for Sango-Ota. Inside one letter wey date May 23, di Ogun State Attorney General and Commissioner for Justice, Oluwasina Ogungbade, tell di AIG make he hands-off di mata since di land […]

todayMay 26, 2026 15

south west

Ogbomoso Teachers Storm Gornment Office, Cry Out Over Kidnap And Teacher Killing

By: Esther Ayoola Teachers for Ogbomoso, Oyo State on Monday lock classrooms oh, and do peaceful protest sake of say jaguda boys carry dia teachers and students. Di protesters carry placards dey beg gornment at all levels, make dem work harder to rescue dia pipo wey kidnappers kidnnap. Di kidnapping for Oriire Local Government don cause serious fear and concern among teachers, parents and residents for di state. To tell […]

todayMay 19, 2026 16

south west

Dapo Abiodun Win APC Ogun East Senate Seat Primary Election

By: Esther Ayoola Ogun State Govo, Prince Dapo Abiodun, don win All Progressives Congress (APC) Ogun East senatorial primary wey hapun on Monday. Returning officer announce am say,  Im collobi  75,550 votes out of 99,503 total votes to carry di ticket. While Former govo, Otunba Gbenga Daniel, get 398 votes while Bukola Braimoh score 29 votes for di election. APC returning officer, Dr. Wale Bello, also break am down say […]

todayMay 19, 2026 16

south west

IGP Order Heavy Security For Oyo Forest Afta Deadly Attack

By: Esther Ayoola Senior man IGP, Olatunji Disu don order make police deploy more tactical team to guide Oriire Local Government Area, Oyo State, afta deadly attack and kidnapping wey hapun around nearby forest areas. Di incident hapun early hours of Friday, 15 May 2026 for Oriire area. Police tuk, tuk, DCP Anthony Placid, tuk say di IGP give di order during im personal visit to Oyo State because of […]

todayMay 18, 2026 22

south west

Bandits Jaguda Storm Ogun Estate, Kidnap Three Family Members as Panic Hit Ijebu-Ode

By: Esther Ayoola Some Gunmen wey pipo suspect as bandits don go invade one residential estate for Ijebu-Ode area of Ogun State, carry three family members. Police tuk, tuk, Oluseyi Babaseyi, naim dey konfam dis incident to tori pipo on Tuesday. Reports tuk say about 15 armed men enter one Estate for Oke-Eri, enter di house, ransack am, before dem kidnap di victims. Di head of di family, Yesiru Badewa, […]

todayMay 13, 2026 13

south west

Ogun State Catch 45 Pipo Say Dem Park Dirty For Road

By: Esther Ayoola Ogun State Waste Management Authority officials don arrest and sentence not fewer than 45 residents to community service because say dem dump dirty anyhow for roadsides and public places. According to di Ogun state waste management pipo, di arrest hapun for Quarry Road and Kolobo area. Konfaming di report, Agency adviser, Farook Akintunde, say di action na to end yangayanga throwing of dirty for Ogun state and […]

todayMay 8, 2026 13

south west

Makinde Meet Peter Obi For Ibadan To Discuss 2027 Coalition Plan

By: Esther Ayoola Oyo state govo Seyi Makinde and di 2023 labour party presidential candidate don run anoda closed door meeting. Say di Oyo state Govo host Peter Obi with im delegation for im Office for Agodi, Ibadan on Tuesday. Speaking with tori pipo afta di meeting, Obi say di visit na part of ongoing tuks and consultation about coalition wey dem dey plan run for 2027 general elections. Dis […]

todayApril 29, 2026 22

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds