Sports

802 Results / Page 9 of 90

Background

Sports

Atletico Madrid Reject Real Madrid €150m Bid For Julián Álvarez Deal

By: Esther Ayoola Real Madrid don reportedly offer €150 million to sign Argentine striker Julián Álvarez from city rivals Atlético Madrid. Dis na according to statement wey appear for dia website. Di club say di proposal come afta board meeting wey dem hold as dem dey look for top striker to strengthen dia attack. But Atlético Madrid quickly reject di offer, say Álvarez dey very important for dia project and […]

todayJune 10, 2026 7

Sports

Ebola Scare Shake Dr Congo World Cup Prep

By: Esther Ayoola Democratic Republic of Congo dey fall hand oh, losing 2–1 to Chile for friendly match wey dem play for France on Tuesday, put am for Ebola head Di match suppose hapun for southern Spain, but di mayornor gree based on Ebola concern, naim make dem con move go France, and now dem con lose World Health Organization don declare international health emergency over di Ebola outbreak wey […]

todayJune 10, 2026 9

Sports

Serena Williams Return with Big Win for Queen’s Club Doubles

Senior woman, Serena Williams don make ogbonge winning return to tennis for Queen’s Club doubles on Tuesday. Di American legend wey don win 23 Grand Slam titles team up with Canada teenage Queen, Victoria Mboko, and dem beat Erin Routliffe and Nicole Melichar-Martinez 7-6 (7/2), 6-2 for first round. Mama Sere, Sere, wey shock plenty pipo last week unto say, seh tuk say, she wan return to playing, say she […]

todayJune 10, 2026 8

Sports

Chelsea, Man City Drag Over Maresca Deal For Guardiola Job

By: Esther Ayoola Chelsea and Manchester City negotiations for Enzo Maresca to replace Pep Guardiola don enter go slow because of compensation mata. Guardiola don already announce say im go leave City afta many successful years, and City want Maresca take over. But Chelsea dey insist say dem suppose pay money because Maresca sti get contract with dem before he comot Stamford Bridge. As things stand, both clubs sti dey […]

todayJune 9, 2026 14 4

Sports

Edo Queens Hammer FC Robo 4-1 For Super Six Clash

By: Esther Ayoola Edo Queens of Benin don beat FC Robo 4-1 for dia second match of di 2026 NWFL Premiership Super Six wey happen for Port Harcourt. Dem bin lose dia first game 1-0 to Nasarawa Amazons, so, dem need dis win to stay inside competition. Esther Moses open scoring for 15th minute, while Chioma Moses add second goal before halftime to put Edo Queens ahead. For second half, […]

todayJune 9, 2026 13

Sports

Super Falcons Show Power

Nigeria Super Falcons show say dem ready oh for WAFCON 2026, beating  Senegal 3-0 for dia second friendly match for Ikenne, Ogun State. Di win complete double victory for di African champions after dem first beat di Teranga Lionesses 2-1 on Friday. Coach Justin Madugu and im players dominate di game from start to finish, create plenty chances even though Senegal defence try hold ground for first half. Di result […]

todayJune 9, 2026 9

Sports

Portugal Star Rafael Leão Out Of Naija Match Afta Red Card

By: Esther Ayoola Portugal winger Rafael Leão no go play for dia  final World Cup warm-up match against Naija on Wednesday afta im collect red card against Chile on Saturday. Referee bin comot Leão for pitch before half-time because he give Chile defender, Ivan Román, one heavy blow for face. Even though Portugal play with ten men, dem sti bounce back beat Chile 2-1 as Gonçalo Guedes and Bruno Fernandes […]

todayJune 8, 2026 10

Sports

How Denmark Star Christian Eriksen Faint Again For Field

By: Esther Ayoola Say nor be small fear catch fans on Sunday as Denmark midfielder, Christian Eriksen, fall down for pitch during dia friendly match against Ukraine. Dis badness dey hapun for di second time to di 34-year-old player afta im heart first stop during di Euro match against Finland five years ago. Di Danish Football Association don bring statement say Eriksen eye dey open and im dey receive treatment […]

todayJune 8, 2026 9

Sports

Afta Four Hours, Zverev Colobi First Grand Slam Trophy

World number two tennis player, Alexander Zverev, don finally carry im first Grand Slam trophy after he beat Flavio Cobolli from Italy inside one heavy five-set match for di French Open final on Sunday. As di Senior player dey court di paly di game, na so im family dey church dey fire prayer. Di German guy play for four hours and 16 minutes before he fit win Cobolli 6-1, 4-6, […]

todayJune 8, 2026 11 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds