Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
First Half
As we enter di 10th minutes for Manchester United Carabao Cup match against Brighton, everything dey shine shine for United as Young winger, Shea Lacey tear net with debut goal. Mason Mount follow am two minutes later with better volley wey bounce for ground before e touch net, and united dey lead 2-0, Old Trafford dey shake, and di night dey look like another step forward for Michael Carrick as him wan show more workings and doings on top di Manchester United project.
Before we close and open our eyes, everything don spoil. Brighton don score three goals, waka comot with 3-2 win, and comot United from Carabao Cup.
Man U fans shock, everywhere blur for dem because na di first time in 50 years wey Manchester United go suffer for Old Trafford after dem don dey lead by two goals be this.
Di last time wey that one happen na September 1976, when Tottenham also come from 2-0 down to beat dem 3-2.
But di painful part for Manchester United no be just say dem lose, na di way wey dem lose.
For di first ten minutes, United be like team wey don finally arrive, Shea Lacey, wey dey make im first start for di club, give di home fans di perfect start for di eighth minute.
Lacey collect di ball inside Brighton penalty area, take on two defenders, shift am go im left foot and fire am towards Jason Steele near post, e no fit stop am.
Lacey turn go celebrate as everywhere bust with noise. Every young player go wish say na im score dat kind goal for im debut game.
United no finish for there ooo.
Barely two minutes later, Mason Mount double di advantage as Marcus Rashford test Steele, di keeper push di ball comot but e no clear am. Na so Mount volley di ball enter net.
Goaaaaal 2-0
For Carrick, na exactly di kind start wey fit calm di questions wey dey follow di team after difficult beginning to di season. But Brighton slowly begin change di story, dey find space and chances.
Di first major warning come when Malick Yalcouye find himself one-on-one with United goalkeeper Karl Darlow, he get chance to bring Brighton back inside di game, but im effort go wide. United survive that one.
Brighton kon follow am with another warning as dem continue to push forward and di pressure eventually pay.
As first half enter stoppage time, Brighton send long ball forward towards Charalampos Kostoulas.
Kostoulas reach di ball first, beat Darlow and fire am through di goalkeeper legs.
Goaaaaaal 2-1, Brighton score. Now Brighton don get goal, confidence and second half dey to complete di comeback.
Second Half
United enter half-time still dey lead, but di feeling inside Old Trafford don change. Brighton don get reason to believe say dem fit beat United, and after di restart, dem begin push harder.
Brighton continue to look for di opening wey go bring dem level, as Manchester United struggle to create another serious chance.
Then, after 65 minutes, di opening come, Luka Vušković send long ball forward, Pascal Groß chase am and battle him way inside United penalty area.
Benjamin Šeško challenge am, but di ball break kindly for di Brighton midfielder. Groß keep im composure and finish from close range.
Goaaaaaal 2-2, Brighton equalize. Di comeback don complete.
Wetin look like comfortable Manchester United victory after ten minutes don suddenly turn to completely different football match.
And that one no do Brighton. Four minutes later, dem strike again.
Maxim De Cuyper Enter Game
Diego Gómez drive di ball forward before finding Maxim De Cuyper inside United area.
De Cuyper just enter di game, but he no need invitation.
He take di chance and fire past Darlow.
Goaaaaaal 3-2, Brighton don do am.
From 2-0 down to 3-2 up.
Everywhere blurrrrr.
United try to respond, as Rashford come close for 76th minute, but Jason Steele stand strong and make di save.
United try and try but nothing come out.
And when final whistle blow, di visitors don complete one of di most remarkable comebacks Old Trafford don see for decades.
Di result add to Carrick already difficult start.
United don win only one of dia first four Premier League matches, and now di Manchester derby defeat don follow with another cup exit.
Na why di next few weeks go matter.
Carrick enter di season with expectation after he guide United finish third last season and win 12 out of 17 Premier League matches after taking charge.
Di expectation be say dis season go build on dat progress. Instead, United don find themselves looking for consistency again.
Di Brighton match show both di promise and di problem.
Lacey and Mount give United di explosive start wey dem need.
But once Brighton change di momentum, United struggle to take control back.
Now Fulham dey wait on Sunday.
For Carrick and im players, di job simple: turn dis terrible night into response for pitch.
Because after Manchester United go from 2-0 up to 3-2 down, dem no need another explanation.
Dem need reaction.
Written by: Rilwan Agbomeji
article Brighton Carabao Cup MANCHESTER UNITED
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026
This will close in 0 seconds