Sports

805 Results / Page 10 of 90

Background

Sports

Portugal Star Rafael Leão Out Of Naija Match Afta Red Card

By: Esther Ayoola Portugal winger Rafael Leão no go play for dia  final World Cup warm-up match against Naija on Wednesday afta im collect red card against Chile on Saturday. Referee bin comot Leão for pitch before half-time because he give Chile defender, Ivan Román, one heavy blow for face. Even though Portugal play with ten men, dem sti bounce back beat Chile 2-1 as Gonçalo Guedes and Bruno Fernandes […]

todayJune 8, 2026 10

Sports

How Denmark Star Christian Eriksen Faint Again For Field

By: Esther Ayoola Say nor be small fear catch fans on Sunday as Denmark midfielder, Christian Eriksen, fall down for pitch during dia friendly match against Ukraine. Dis badness dey hapun for di second time to di 34-year-old player afta im heart first stop during di Euro match against Finland five years ago. Di Danish Football Association don bring statement say Eriksen eye dey open and im dey receive treatment […]

todayJune 8, 2026 9

Sports

Afta Four Hours, Zverev Colobi First Grand Slam Trophy

World number two tennis player, Alexander Zverev, don finally carry im first Grand Slam trophy after he beat Flavio Cobolli from Italy inside one heavy five-set match for di French Open final on Sunday. As di Senior player dey court di paly di game, na so im family dey church dey fire prayer. Di German guy play for four hours and 16 minutes before he fit win Cobolli 6-1, 4-6, […]

todayJune 8, 2026 11 1

Sports

Rivers United Players Get Askident As Dem Dey Travel For President’s Cup Match

By: Esther Ayoola Wahala hapun on Thursday say NPFL side, Rivers United, get road aakident as dem dey travel go Awka for Anambra State for dia President’s Cup match against Nasarawa United. The club konfam inside one statement say the accident hapun for Obiri-Ikwerre Airport Road outskirt of Port Harcourt, just after di team leave dia camp. Naso some players and officials get small-small wounds for body, but thank God […]

todayJune 5, 2026 12

Sports

Liverpool Sign Andoni Iraola

Liverpool done officially appoint former Bournemouth coach, Andoni Iraola, as dia new manager on Thursday. Dis one dey hapun after dem sack Arne Slot last Saturday bicoz di poor team performance. Di 43-year-old Spanish coach tuk for interview say he dey over jolly to join di club, as everybody know say Liverpool na one of di biggest teams for di whole world.

todayJune 5, 2026 11

Sports

Poland Fall Super Eagles Hand

Naija Super Eagles drop standard last-minute as Poland hold dem to 2-2 draw for inside Warsaw on Wednesday. Terem Moffi naim bin give Naija the lead for 23 minutes, but Poland score back before half-time. As di match almost finish, Przemysław Wiśniewski just sharply score with di last kick of di game to spoil Nigeria win.

todayJune 4, 2026 15

Sports

Liverpool Appoint Iraola As New Manager Afta Slot Sack

By: Esther Ayoola Liverpool don reach agreement to appoint Andoni Iraola as dia new manager afta successful tuks. Transfer expert Fabrizio Romano confirm di deal for X, say agreement don almost complete with im famous “here we go” update. Dis move come just few days afta di club sack Arne Slot following end-of-season review of dia performance. Iraola, wey lead AFC Bournemouth finish sixth and secure dia first-ever European qualification, […]

todayJune 3, 2026 8

Sports

Late Drama As Wales Hold Ghana 1-1

By: Esther Ayoola Lewis Koumas score late equaliser for added time as Wales draw 1-1 with Ghana for friendly match wey happen for dia home ground. Di result mean say Ghana never fit win any of dia last four matches, with three losses and one draw for dia recent games. Di Black Stars miss chance to start well under coach Carlos Queiroz as part of dia preparation for World Cup.

todayJune 3, 2026 8

Sports

Messi to Lead Argentina 26-Man Squad For World Cup

Argentina  coachie, Lionel Scaloni don release im  26 players wey im wan carry go di 2026 world cup say na Lionel Messi go lead dem. Di 38-year-old football king na im top di list, but one big surprise na say Real Madrid star boy Franco Mastantuono no dey among di players wey dey go di tournament. Dis major competition go make am di sixth time wey Messi dey play for […]

todayMay 29, 2026 21 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds