Sports

330 Results / Page 21 of 37

Background

Sports

PSG Beat Leverkusen 7-2 For UCL

Ousmane Dembele show im return from injury sharp sharp as PSG run Bayer Leverkusen street 7-2 for Champions League match wey happen for BayArena stadium, Germany. Dembele score PSG sixth goal just three minutes after im enter second half for im first game since im hamstring injury from September. Desire Doue score two goals, while Willian Pacho, Khvicha Kvaratskhelia, Nuno Mendes and Vitinha add dia own goal as PSG show […]

todayOctober 22, 2025 4

Sports

Newcastle Thrash Mourinho Benfica For Champions League

Harvey Barnes score two goals from bench as Newcastle carry 3-0 hammer land Jose Mourinho Benfica for Champions League showdown for St. James’ Park. Anthony Gordon open di scoring for first half, as Benfica still dey waka with zero point for dis Champions League season. Barnes enter after one hour play and scatter di show with two correct right-footed finishes wey help Newcastle dey on track to qualify from di […]

todayOctober 22, 2025 6

Sports

Cristiano Ronaldo Pikin Don Get Him First Call-Up To Play For Portugal U16 Team

Cristiano Ronaldo pikin, Cristiano Ronaldo Jr, don get him first-ever call-up to Portugal U16 team. Di 15-year-old wey dey play for Al Nassr youth team for Saudi Arabia, same club where im papa dey ball, land inside 22-man Portugal squad wey go play for di Federations Cup Tournament for Turkey. Di tournament go run from October 30 to November 4, and Portugal go face Turkey, Wales and England for di […]

todayOctober 22, 2025 6

Sports

LaLiga Don Cancel Barcelona vs Villarreal Match Wey Dem Wan Play For Miami

LaLiga don cancel dia big plan to play Barcelona vs Villarreal match for Miami dis December. Dem announce am on Tuesday say na Relevent, di league’s partner for North America, pull plug because of di wahala and kata kata wey di match don cause for Spain. According to LaLiga, di mata don bring serious gbas gbos and uncertainty for Spain, so dem no fit go ahead again. Dem talk say […]

todayOctober 22, 2025 6

Sports

Remo Coach Sure Say Dem Go Bounce Back Against Sundowns

Remo Stars coach, Thiago Conde, don talk say di team CAF Champions League journey never finish, even after dem chop 5–1 disgrace for dia home ground in Abeokuta from South African giants Mamelodi Sundowns on Sunday. After di match, Conde admit say him players no follow di game plan well, but still believe say comeback fit still happen for second leg. Him praise di team spirit despite di heavy loss […]

todayOctober 22, 2025 6

Sports

U-17 WW’Cup: Flamingos Wan Take Revenge for France

Nigeria U-17 girls wey dem dey call Flamingos, dey prepare to take revenge against France for dia second Group D match for FIFA U-17 Women’s World Cup wey dey happen for Morocco today (Wednesday). Dem suffer heavy 4–1 loss to Canada for dia first match, and dis one make dem dey bottom of di table with zero points and minus-three goal difference. If dem no fit beat France by 8pm […]

todayOctober 22, 2025 7

Sports

Lopez, Rashford Dey Hot As Barca Thrash Olympiacos 6-1

Fermin Lopez bag hat-trick and Marcus Rashford score two as Barcelona knack Olympiacos 6-1 for Champions League group stage match on Tuesday. Di Catalan giants bin need dis win after dem lose to PSG last time, and dem no waste time bounce back. Teenage baller Lamine Yamal still chop goal as Hansi Flick men, wey dey short of top players like Lewandowski and Raphinha, run riot for Estadi Olímpic Lluis […]

todayOctober 22, 2025 8

Sports

Arsenal Na Kings of Spain, Gunners Smash Record After Dem Wipe Atletico

Arsenal raise plenty eye for Europe after dem hammer Atletico Madrid 4-0 for Emirates Stadium on Tuesday night. But no be only one-off win for Mikel Arteta side, na historic run dem dey make as dem don win seven straight games against Spanish teams for Champions League, something no other team don ever do before. Dem beat Atletico after dem already knack Athletic Club, Real Madrid (home and away), Girona, […]

todayOctober 22, 2025 8

Sports

Nottingham Forest Don Name Sean Dyche As Third Coach 2025-26

Di Aussie coach chop sack just few minutes afta Chelsea knack Forest 3–0 on Saturday afternoon. Di club no waste time as dem sharply bring in Dyche to try rescue di season wey don dey scatter. Postecoglou own short and bitter 39-day stay no produce single win inside eight matches for all competitions. Na serious wahala as di poor results drag Forest go relegation zone and make dia fans vex […]

todayOctober 21, 2025 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app