Sports

980 Results / Page 40 of 109

Background

Sports

How Maguire Sign New Contract With Man Utd

By: Esther Ayoola Manchester United don renew contract of dia former captain Harry Maguire, so like dis im go dey Old Trafford for at least another season. Di 33-year-old England centre-back, wey join United from Leicester for £80 million back in 2019, sign new one-year deal with option to extend further. Maguire take to im social media, express im happiness, say di tin sweet am, dat Representing Manchester United na […]

todayApril 7, 2026 27

Sports

Carragher Explain How Liverpool Go Take Replace Salah

By: Esther Ayoola Liverpool legend Jamie Carragher don scatta table again oh, say di club nor go get problem replacing Mohamed Salah wen Salah go comot by di end of 2025/26 season. E tuk dis tuk for Liverpool website say plenty great players bin play for Anfield before Salah. E explain say nobody dey for football, wey dem nor fit replace, even though say im na goal scorer. Carragher believe […]

todayApril 7, 2026 26

Sports

CAF Presido, Motsepe Dey Enter Dakar AFCON 2025 Settlement

By: Esther Ayoola CAF Presido, Patrice Motsepe, according to Kenyan media Tuko, dey plan enter Dakar, Senegal on Tuesday following Senegal 2025 AFCON gbege. CAF Appeals Board give Morocco 3-0 win because Senegal comot for pitch to protest during di final. Senegal Football Federation say dem nor go gree and don carry di mata go Court of Arbitration of Sports for Laussane, wey fit take 12 months to settle. Say […]

todayApril 7, 2026 20

Sports

Barcelona Eye Victor Osimhen As Atlético Hold Julián Álvarez Tight

By: Esther Ayoola Barcelona don start dey look Victor Osimhen as pa say Atlético wan stress dem for Julián Álvarez deal. According to transfer experts, dem bin first want Álvarez for dis summer transfer window, but Atlético dey hold dia player kakaraka. Now, Barcelona dey reason both Álvarez and Osimhen as possible way dem fit replace veteran forward Robert Lewandowski. Álvarez dey cost around €200m, wey fit make am one […]

todayApril 7, 2026 37

Sports

Mbappe Set To Shine As Madrid Face Bayern For UCL Clash

Real Madrid coachie Arbeloa don konfamate say, star boy, Kylian Mbappe go dey available for di Champions League clash with Bayern Munich on Tuesday. For Pre match conference, Di Coachie explain say Mbappe na very important player for di team. Mbappe wey be their top scorer nor start di last games against Manchester City because of knee injury, but di team still win wella. Now wey e don recover, coach […]

todayApril 6, 2026 32

Sports

Inter Milan Extend Dia Lead For Seria A Beating Roma 5-2

Inter Milan  knack Roma 5-2 for Serie A inside San Siro on Sunday, to take dia lead to nine points ahead of AC Milan. Lautaro Martinez come back from injury, score two goals, while Marcus Thuram score im first goal since February. Hakan Calhanoglu score beta shot before half-time and Nicolo Barella add another one, making it a sure win.

todayApril 6, 2026 27

Sports

Chukwuma Beat Ofili, Win First Outdoor Doings For Louisiana

Nigerian sprinter Rosemary Chukwuma don start her outdoor season with beta result, wining di Battle for Bayou matas wey hapun for Louisiana. She run 10.81 seconds (+3.1 m/s) to beat her training partner Favour Ofili and Canada’s Audrey Leduc, wey finish together for 10.93 seconds. Chukwuma pick race for di blocks, sharp-sharp and hold her lead till di finish, even as Ofili try rush at di end. Dis timing sef […]

todayApril 6, 2026 23

Sports

Remo Stars Nail 3SC, Kano Pillars Hammer Bendel Insurance 4-0

Interesting games na sup for di Nigeria Premier Football League, match day 33, say Remo Stars record 1-0 win over Shooting Stars for Ikenne on Sunday as Samuel Anakwe score di only goal after half-time. For other matches, Kano Pillars hammer Bendel Insurance 4-0, while Kwara United waka pass El-Kanemi Warriors 3-0. Rivers United lose 2-0 to Warri Wolves as Nasarawa United collect 0-1 lose to Kun Khalifat.

todayApril 6, 2026 24

Sports

Chelsea Suspend Enzo Fernandez Say Im Break Club Rules

Say like dis na, Enzo Fernandez no go play for Chelsea for di next two matches after im talk about im future. Dis na according to update by coachie Liam Rosenior for im pre match conference. According to Rosenoir, di club get ruled and Enzo don pass di line as make comment say im wan join Real Madrid. Di 25-year-old Argentine wey join Chelsea January 2023 for record £107 million, […]

todayApril 3, 2026 37

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds