By: Esther Ayoola
Solicitors wey dey represent Nigerian senior writer Chimamanda Adichie don write letter to Euracare Multi-Specialist Hospital, Lagos, over di death of her 21-month-old pikin, Nkanu Nnamdi, wey die on Wednesday, January 7, 2026.
Di lawyers, Prof Kemi Pinheiro (SAN), claim say di hospital, di anaesthesiologist, and attending medical staff breach di duty of care wey dem suppose give di pikin.
Lagos State Gornment don confirmate say dem suspend di anaesthesiologist as dem dey investigate wetin happen for di hospital.
Chimamanda and her partner, Dr Ivara Esege, dey pursue di matter to ensure accountability and justice for di death of dia son.