By : Jolayemi Olajide
Senior man leader of di Nigeria Democratic Congrees, Seneta Seriake Dickson don beg Peter Obi, Rabiu Kwankwaso and oda NDC candidates make dem no dump di party after Federal High Court judgment for Lokoja.
U sabi Di court cancel im earlier order wey direct INEC to register NDC, say one Peace Movement Party dey claim di party logo.
Dickson say make all aspirants remain calm as di party go pursue legal way to settle di mata.