Edo State House of Assembly Speaker, Blessing Agbebaku, don resign on Monday as some lawmakers dey move to impeach am, and im media aide, Ivy Ebojele, konfamate say he don comot.
After di resignation during Monday plenary for Edo Assembly, Yekini Idiaye, wey represent Akoko-Edo Constituency 1, don emerge as di new Speaker.
Idiaye tell journalists after di sitting say Agbebaku leave office because of poor leadership and alleged corruption, with too many adjournments during im time as Speaker.