Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
The Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don talk say dem don arrest 17 people wey dem suspect say dey do internet fraud for Lagos. EFCC confirm the arrest for one post wey dem share for their official Facebook page on Tuesday. Dem talk say the suspects dem catch them during one sting operation wey happen on Tuesday for Olusi Street, HopeVille Estate, Sangotedo, Ajah, Lagos.
Dem talk say the arrest follow better correct information wey reach dem hand say thepeople dey involved for internet fraud. EFCC still talk say when dem arrest the suspects, dem recover five motor, mobile phones, and laptop computers from their hand.
Written by: News Editor 1
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025