Sport Yarns

FIFA Select 11 Man Team to Analyse Players and Teams For Award For 2026 World Cup

todayMay 11, 2026 3

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

FIFA don announce 11-member Technical Study Group wey go analyse matches and decide winners of major individual awards for di 2026 World Cup.
Dem unveil di panel on Monday during virtual media briefing ahead of di tournament wey go start next month for Estadio Azteca.

Di group go dey led by FIFA Senior Football Expert, Pascal Zuberbühler, and e include big football names like Pablo Zabaleta, Jürgen Klinsmann, Michael O’Neill, Otto Addo, Paulo Wanchope and Gilberto Silva.

Other members for the panel na Tobin Heath, Jon Dahl Tomasson, Jayne Ludlow and Aron Winter.
Di Technical Study Group go monitor games throughout di competition and hellep FIFA decide major individual awards based on player performances.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds