Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Four police officers don lose dia job after dem go involve demselves for di killing of seven traders for Owode Onirin market, Lagos, for August 2025.
Lagos State Police Commissioner, Olohundare Jimoh, na im dey align di mata give tori pipo on Thursday, say dem take part for di unlawful killings.
Jimoh explain dat, di traders dem kpai during fight wey hapun between landgrabbers and traders for Owode-Onirin area.
Jimoh say, di dismissed officers, say na from Nasarawa dem take bring dem, by suspect ‘Ariori’, na why dem involve for di tragic killings, and dat investigation still dey go on.
Written by: Ridwan Agbomeji
nigeria police force disciplinary action nigeria police officers sack owode onirin market news police misconduct nigeria police officers dismissal news
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026