By: Rilwan Agbomeji
Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don break silence on di fire wey shake Great Nigeria Insurance Building for Martins Street, Lagos, oga go see di place, dey beg people make everybody calm down.
Sanwo-Olu yarn dis one through Information Commissioner, Gbenga Omotoso, for statement wey im drop Thursday.
Sanwo-Olu say emergency teams don control di fire and situation dey under check.
Good news be say no single life loss, as responders still dey sweep di area and secure di scene make wahala no start again.