Local

“How Dem Fit End Insurgency Within Six Months” – Gen. Ishola Talk

todayAugust 29, 2025 6

Background
share close

Bandits don dey attack different parts of the country, and the latest one na the attack wey happen for one mosque for Katsina State, wey over dem kill 30 worshippers. On Friday, Former Chief of Defense Training and Planning, General Ishola Williams wey don retire talk say e believe say Nigeria fit end all dis security wahala within six months. Williams talk dis one for Channels Television program wey dem call Sunrise Daily, say government no even need to dey buy new weapons every time. “All these problems fit solve within six months. Make dem just rearrange the security agencies,” na so e take talk.

The retired general talk say make dem maintain the weapons wey military already get and build better technical, intelligence and counterintelligence systems. “Train the soldiers well well. Ask any soldier for North-East or South-East, ‘wetin you dey fight for?’ Nobody don ever explain wetin dem dey fight for. If dem no sabi why dem dey fight, dem go just take am like normal work. If dem tire, dem don tire. He talk say cases don dey when soldiers run away from Boko Haram attacks. Williams also complain say some communities still dey support terrorists and bandits, and e dey make government job hard. E even ask wetin traditional rulers dey do, say dem suppose dey help tell people make dem work with security people. On the issue of arms smuggling, e call on Immigration, Customs and Police make dem join hand together well well, because some officers dey help smuggle arms enter Nigeria through border.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app