By: Esther Ayoola
Di Inspector General of Police, Rilwan Olutunji Disu don order make dem sack and prosecute di police officers wey shoot one civilian for Effurun, Delta State.
U sabi di internet dey hot dis week as a uniform olokpa go kpai one man by name, Mene Ogidi
For press briefing wey hapun for Abuja on Wednesday, di IGP point finger for ASP Nuhu Usman as di main officer wey do di killing.
E say di officer break police rules, including Force Order 247 wey control how officers suppose use gun.