IGP Disu

4 Results / Page 1 of 1

Background

Lagos

Lagos Police To Arrest Cars

Lagos State Police Command don announce say dem go start statewide jogolo against motors wey get covered, fake, defaced or no plate number to improve security and reduce crime. Police tuk, tuk, SP Abimbola Adebisi, talk say di order come from Inspector-General of Police, Olatunji Disu, and e go start on Monday, June 15, 2026, under CP Tijani Fatai supervision. To tell u how di mata serious reach, commissioner of […]

todayJune 15, 2026 10 1

National

IGP Disu Promote 374 Kwara Police Officers

By: Shalom Ovie IGP Olatunji Disu promote 374 police officers for Kwara State Command say make dem go rake out jaguda boys. Police tuk, tuk, Adetoun Ejire-Adeyemi, naim announce di promotion for Friday as part of nationwide exercise. According to am, 365 constables, two corporals, five sergeants and two superintendents benefit from di promotion. Police say di exercise na to reward officers wey dey work hard and serve well.  

todayJune 12, 2026 13

National

IGP Disu Say Make Dem Sack, Charge Police Wey Kpai Civilian for Effurun 

By: Esther Ayoola Di Inspector General of Police, Rilwan Olutunji Disu don order make dem sack and prosecute di police officers wey shoot one civilian for Effurun, Delta State. U sabi di internet dey hot dis week as a uniform olokpa go kpai one man by name, Mene Ogidi For press briefing wey hapun for Abuja on Wednesday, di IGP point finger for ASP Nuhu Usman as di main officer […]

todayApril 30, 2026 21

Uncategorized

IGP Disu Vow For Abuja To Tighten Police Accountability

By: Esther Ayoola Oga Inspector-General of Police, Olatunji Rilwan Disu, on Thursday for Abuja don promise say him go strengthen accountability for Naija Police Force. Him yan dis one as him meet Civil Society Organizations for Force Headquarters. Di CSO group wey human rights lawyer Femi Falana lead, enter dis meeting just to push for police reforms and beta protection of citizens’ rights. Disu nor close mouth too, say di […]

todayApril 10, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds