Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Oga Inspector-General of Police, Olatunji Rilwan Disu, on Thursday for Abuja don promise say him go strengthen accountability for Naija Police Force.
Him yan dis one as him meet Civil Society Organizations for Force Headquarters.
Di CSO group wey human rights lawyer Femi Falana lead, enter dis meeting just to push for police reforms and beta protection of citizens’ rights.
Disu nor close mouth too, say di reforms go hapun through joinbodi with civil society and respect human rights.
Cue sound
Falana praise Disu for him vision of human rights-based policing, but im tuk say police must obey Naija Police Act 2020, especially on how dem treat suspects.
Written by: News Author
Abuja police IGP Disu Kayode Egbetokun Disu NIGERIA POLICE FORCE police accountability Nigeria
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026