By: Jolayemi Olajide
INEC don bring QR code wey Lagos voters fit use find where dem go check dia names for voter register.
INEC Resident Electoral Commissioner for Lagos, Prof. Ayobami Salami, announce dis one on Tuesday, as e say dem don start to display voter register since October 9 for all 245 wards across di state.
Di exercise go end October 15, and e go help voters check dia details and correct any mistake wey dem notice.
Salami urge voters make dem use di opportunity before deadline, as Lagos get 7,488,633 registered voters, pass every oda state for Naija.