Iran military don sama warning say dem go block trade for Red Sea, Gulf, and Sea of Oman if US naval blockade on Iranian ports continue.
Military commander Ali Abdollahi and Iran central command na im tuk dis one for State broadcast.
According to di senior men, US dey create cause problem for Iran ships and oil tanker movement, and dis sef violate dia ceasefire agreement.
Military commander Ali make clear dat dem ma ready to protect dia national interest and sovereignty.