Di pipos democratic party 2023 lagos governorship candidate, Dr Abdul-Azeez Adediran wey dem sabi as Jandor don talk say im still dey inside 2027 Lagos governorship race.
Dis one happen even as plenty APC leaders dey endorse Deputy Governor, Dr Obafemi Hamzat, for di position.
Pipo like Governor Sanwo-Olu, Speaker Mudashiru Obasa and Chief of Staff Femi Gbajabiamila don show support for Hamzat.
Reacting, Jandor tuk say e respect all di endorsements but insist say party rules on direct primaries must still stand.