By: Esther Ayoola
Former NBA player Jason Collins don kpai for age 47 afta im battle with brain cancer, im family announce am.
According to report, say e kpai afta wetin dem describe as “valiant fight” against glioblastoma, serious brain cancer wey no get cure.
According to NBA announcement wey BBC report on Wednesday, Collins first reveal for 2025 say him get di sickness afta him begin get problem with concentration, before doctors confirm brain tumour.
Di former basketball star Kpai because di fast-spreading cancer dey grow for im brain, and di family announce di news to show how he struggle fight di illness till im last moment.