OBODO NAIJA

Justice Crack Bail Hearing jam rock say Lawyers dey fight for who go Lead

todayMay 14, 2026 1 2

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Di bail hearing of Nigerian activist, Justice Chidiebere, popularly known as Justice Crack, on Thursday say im village pipo follow am enter Federal High Court Abuja, na so lawyers dey fight, dey fight na me go tuk, na me go tuk.

To di point dat everybody con confuse whether na show of love abi na village pipo performance, na judge pulse di hearing adjourn mata till Monday, May 18, for fresh application hearing.
One of im lawyers, Femi Balogun, say another counsel, Marshall Abubakar, naim dey try block di bail process sake of say dem nor gree am to lead.
Di case now dey wait for new legal direction as defence team internal conflict delay proceedings.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds