By: Esther Ayoola
Teachers for Oyo State public primary and secondary schools don begin strike from June 1, 2026, as Naija Union of Teachers (NUT) order all members make dem stop work.
Di union say na sake of wetin jaguda boys do to teachers and pupils for oyo state naim make dem dey protest.
NUT tuk say di mata don cause fear and panic among teachers and parents across di state.