Lagos

Lagos AG Tuk Why Dem Free Di Suspects Of Owode Killings, Say Evidence

todayApril 24, 2026 2

Background
share close

By: Esther Ayoola

Lagos State Attorney-General, Lawal Pedro, don explain why Lagos gorment free di suspects wey bin dey dia net for di killing of six traders for Owode Onirin, dat gornment no dey hide anybody wey dey  involve.

E say decision not to charge di suspects na because akelebe investigation no show clear evidence wey  link them to di crime.

According to am, di black uniform men, wey we sabi as police send di case file give Ministry of Justice afta dia initial findings, as law require.

Afta checking di witness and di suspects statements, di gornment con  conclude say no strong case, so dere was no need to keep dem.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app