Minister of Works, Dave Umahi, don describe Lagos-Calabar Coastal Highway as di best gift Presido Bola Tinubu administration don give Nigerians.
E make di statement on Monday for flag-off of di dualisation of Ibadan-Ijebu-Ode road along Idi Ayunre axis for Ibadan.
Umahi tok say pipo for Lagos don dey feel di benefit of di road as journey from Epe to Lagos wey dey take seven to eight hours before, now fit take about 15 minutes.