By: Esther Ayoola
Oga Works and Infrastructure Supervisor for Eredo Epe Local Council Development Area, Bayo Opetuga, don call on residents make dem protect public infrastructure for dia communities.
Opetuga tuk dis one on Monday during inspection of projects wey di council execute for Eredo Epe area of Lagos State.
E explain dat, when pipo protect gornment facilities, e dey always hellep preserve di gorment project stay longer.
Di council official sti warn residents to stop vandalism and careless attitude toward public property because e dey affect di common good of everybody.