By: Esther Ayoola
Lagos State Fire and Rescue Service don launch Fire Marshal Club and carry out Safety Walk to waka town make pipo sabi how to prevent fire and respond in emergency.
Say, di awareness waka start from dia headquarters for Alausa, Ikeja, pass Ikeja Fire Station, then return headquarters on Sunday.
According to di Controller General, Margaret Adeseye, di way fire dey worry Lagos, too much, however cases don reduce small from 2024 reach 2025.
She sha jinger boys and girls to put bodi for di fire fight training to hellep protect Lagos and environs