By: Esther Ayoola
Following di spirit of 2026 Armed Forces Remembrance Day, Lagos State Gorment don promise oh, say e go continue to dey support armed forces members, whether dem dey alive or dead.
Govo Babajide Sanwo-Olu, wey im deputy, Dr Obafemi Hamzat represent, tuk for Parade ground, say Lagos appreciate di sacrifice wey officers and men of armed forces dey make for di country.
Im say di state dey see dia workings, dat dia face show and dia shoes shine so, go support dem every year and dey ready to do more to hellep dem do dia duty well.