Lagos

Lagos Gornment Explain How Heavy Rain Take Wound Lagos Roads

todayJuly 17, 2026 6

Background
share close

By: Esther Daniel

Lagos State Public Works Corporation don beg residents make dem get patience as di long rainy season don cause serious flood and spoil many roads and public facilities for different parts of di state.

Di agency tok say di bad roads don make movement hard for motorists, commuters and other residents, but dem dey work round the clock to repair roads and make dem safe for use.
General Manager Tokunbo Ajanaku explain say di heavy rainfall wey Lagos dey experience no be only for di state, as many cities around di world don also suffer flooding and damage to infrastructure.

E assure Lagosians say di corporation go continue repair work and respond quickly to affected areas despite di weather challenges.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds