By: Esther Ayoola
Lagos State Gornment don warn residents make dem stop using unsafe water, say e dey dangerous to health and environment.
Executive Secretary of Lagos State Water Regulatory Commission, Oluwabukola Adeyemo, tuk dis one for one community meeting with water stakeholders for Epe.
She say many water wey Lagos get no dey drinkable, unless dem treat am wella because of salt, dirty substances and heavy metals.
Adeyemo warn say anyhow borehole drilling and poor hygiene fit cause serious waterborne sickness for di state.