By: Yusuf Abuh
Lagos State Gornment don arrest one woman, Mrs McCarthy, for No. 56 Adaranijo Street, Pedro inside Shomolu on Monday, after she send her pikin go pour dirty inside covered gutter.
Lagos State Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, wey disclose dis arrest on top im official X account, warn say any parent wey dey push their pikin to break environmental laws go face heavy punishment.
Enforcement officers bin move enter di area go pick the woman up after concerned residents wey see di play sharp-sharp report her to di gornment.
Wahab con warn Lagosians say di state no go take dis kind behavior at all because blocking of drainage na major reason why flood dey disturb di state.