By: Esther Daniel
Lagos State Gornment don threaten to carry one X user wey people dey call Enugu Loudspeaker go court on Tuesday, after di person post fake video of flood con claim say na Lagos e happen.
Oga Tokunbo Wahab, disclose dis one for X, as he talk say di user break di law when e share misleading video wey no even originate from Lagos at all.
Wahab warn say make nobody think say because dey delete dirty post after gornment debunk am, say di law no go still catch dem for their action.
Di gornment dey stand strong say dey must follow di matter reach di end to show say dey no go tolerate fake news wey dey cause panic inside di state.