Lagos State Police Command don come out explain di Ikorodu viral video wey bin dey cause jogolo before say na old video.
One viral video bin scata soical media dat some fulani men wan bin con kidnap pipo for Ikorodu, police arrest dem.
However senior man police commissioner CP Tijani Fatai, explain di marras for Konfam radio on Monday evening dat di video na about 5 years ago and nor be today mata.
Oga commissioner con sti tell members of di public to look di mata thruway face, dat na old gist , while warning say anybody wey deliberately spread fake news or misinformation go face investigation and possible prosecution according to law.