By: Esther Ayoola
Say accusation reach Police officers for Area H Command, Ogudu Lagos, head dat dem collect about ₦3.3 million ($2,000) from one couple wey dem wrongfully arrest early mor mor, for December 18, 2025.
Some independent investigators ni touchlight dis mata dey tuk say afta di mata trend for X, di police return ₦2.2 million but dey beg make dem keep ₦1 million, say di money dem don already share ham among demselves.
Di independent investigators also tuk dat, di police agree to send 100,000k based on di fact say other officers don collect dia own part, go house.
As at di time Konfam news package dis report, di police never tuk anytin on wetin really play for di mata.