Lagos

Lagos Police Promise Ogbogbo Collab With NYSC Corpers

todaySeptember 2, 2026

Background
share close

Lagos Police commissioner of  police Fatai Tijani don promise NYSC corpers say dem go protect corps members.

Tijani give di assurance on Tuesday during a familiarisation visit by NYSC Lagos Coordinator Mrs Christiana Salmwang to di police headquarters for Ikeja.

Di meeting focus on strengthening di relationship between both organisations and improving security arrangements for corps members wey dey serve for different parts of Lagos.

Tijani say di police go work closely with NYSC to tackle security concerns and protect di safety and welfare of corps members throughout dia national service.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds