Lagos

Lagos Under Flood Attack As Rainfall Ground Businesses, Movement

todayJuly 14, 2026 13

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Heavy rain wey fall for Lagos on Monday scatter business activities as flood cover many areas, make vehicles sink and leave plenty motorists and commuters stranded.

According to report, Places like Ikoyi, Lekki, Victoria Island and Oworonshoki suffer serious flooding as water take over major roads and cause heavy traffic.

Videos from residents show long line of vehicles wey water swallow for hours, while some pipo waka through knee-deep water to reach where dem dey go.

Many Lagos residents talk say di rainfall na one of di biggest for recent weeks, as e delay movement, affect businesses and reduce productivity.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds