Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Lagos state Gornment don deploy 500 extra LASTMA officers for key roads and project corridors for Lagos ahead of President Tinubu visit.
Oga General Manager of LASTMA, Olalekan Bakare, naim dey yarn on Monday during press briefing.
Say, di officers go manage vehicles for major highways and routes wey relate to President itinerary, and dem go dey stationed for strategic areas throughout di visit.
Bakare-Oki explain say di deployment na part of coordinated plan with federal and state agencies to guarantee smooth movement, proper logistics, and safe environment for everybody.
Written by: News Author
BOLA AHMED TINUBU Lagos State Traffic Management Authority Lagos Traffic Control LASTMA Officers Deployment Tinubu Lagos Visit
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026