OBODO NAIJA

Makinde Set Up Panel To Dig Deep Into Oyo School Kidnap

todayJuly 31, 2026 4

Background
share close

By: Esther Daniel

Oyo State Govnor Seyi Makinde don set up eight member Judicial Commission of Inquiry on Friday for Ibadan to investigate di abduction of students and teachers wey happen for Esinele and Yawota communities, Oriire Local Gornment Area, on May 15, 2026.

Makinde, wey inaugurate di panel for Executive Council Chamber, Agodi Secretariat, say di commission no be to question security agencies but to uncover di truth behind di incident.

Di govnor task di panel, led by Prof. Mojeed Owoade, to find out exactly wetin happen, identify any security or operational failures, and establish all di facts.

Makinde say di investigation go help gornment strengthen security around schools and communities so make kidnappers no fit carry out another attack like dat.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds