Manchester United chief executive Omar Berrada and director of football Jason Wilcox don fly go Monaco to do meeting whether Michael Carrick go sti be Man United coachie, after di international break.
According by aproko, wetin dem go discuss for dis meeting, wey dey happen about 800 miles away from Old Trafford on Wednesday, naim go be di final say for di coach.
Report tok say Berrada and Wilcox go likely recommend make di club fire di manager base on hin egbekoro start to di season.
We sti dey hear say di development na big shock for Sir Jim Ratcliffe, wey never expect say e go dey look for new coach again inside less than three years since e buy minority stake for Man United.