Sports

Michael Carrick don salute give Manchester United fans

todayNovember 13, 2026 7

Background
share close

Michael Carrick don salute give Manchester United fans as e write open letter to di fans on Friday, November 13, 2026, just one day after di club comot am from di job as coach.

Di club also announce Mauricio Pochettino as di new manager wey go replace am on di same day.

For di letter, di before before coach thank di fans for dia love and support, even when di team no dey win matches.

E say dia support mean pass winning one or two matches, and na part of wetin make am love di club many years ago.

Di 45-year-old former manager also troway salute give im coaching staff, oda workers and players for dia hard work and loyalty.

E say Manchester United go always remain part of im life, and e go continue to support di team from di sidelines.

Written by: Jolayemi Olajide

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds