Iran army oga di Head of Iran Islamic Revolutionary Guards Corps, IRGC, Commander-in-Chief Ahmad Vahidi, don draw ear give United States say any attack on dem go meet heavy and painful blow.
Commander-in-Chief Ahmad Vahidi tok dis one inside report wey dia tori pipo drop on Friday, November 13, 2026, and e say make di enemy learn from old defeat or dem go see wetin no good.
Dis warning shele after dia forces attack one US radar inside Bahrain.
Iran tok say dem do di Bahrain attack to pay back for US attack on one network mast inside Sirik town.