Uncategorized

Manchester United gree deal wit Pochettino to replace Carrick.

todayNovember 13, 2026 6

Background
share close

Manchester United and United States national team head coach, Mauricio Pochettino, don agree on two-and-half-year deal.

Di 54-year-old coach go replace before before Manchester United head coach, Michael Carrick, wey dem sack on Thursday, November 12, 2026.

Di club bosses don join body wit US Soccer and pay big money for Pochettino contract so e fit finish two matches against Haiti before e fly enter Manchester next week to prepare against Liverpool.

Meanwhile, Manchester United players like captain Bruno Fernandes and defender Harry Maguire don send thank-you messages give Michael Carrick, as before before club captain, Gary Neville, cut chain give club bosses say di way dem treat Carrick do am yama yama for bodi.

Written by: Jolayemi Olajide

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds