By: Esther Daniel
Former Ondo State Gofnor, Olusegun Mimiko, don call for more powers to be given to states and local gornments, im say too much power for the Federal Gornment don cause many of Nigeria’s govrnance problems.
Mimiko make di statement during di RCCG 74th Annual Convention, where e use di biblical “Jethro Principle” to explain say good leadership dey work better wen responsibilities dey shared among capable leaders.
According to am, true federalism go make each state fit handle dia own problems by demsef, while di Federal Government go face national issues like security, defence and foreign affairs. E still praise some steps wey oga presidoBola Tinubu administration don take to share power, but e insist say Nigeria still need bigger constitutional reforms to make true federalism work well.