OBODO NAIJA

Minority Lawmakers Drag Tinubu Gorment Over Insecurity, Hardship

todayJune 17, 2026 3

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Nor be small fire for wi house of representative today, wia  minority caucus drop bars say, President Bola Tinubu nor dey try at all,  dat   insecurity wan finish di giant of Africa.

Dem yarn dis one for National Assembly for Abuja, according to  Minority Leader Fred Agbedi,  Nigeria don enter one of im worst period since 1999 democracy, say dis one, na demonstration of craze .

Agbedi say gornment just dey  focus on 2027 election mata instead of the real suffer, suffer  wey Nigerians dey face, as “Nigeria dey bleed and dey confused.”

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds