Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
One Nigerian businessman wey dey sell jewellery for Lagos don cry come out say thief don pack everything wey dey him shop. The man talk say him name na Clinton, share video for Instagram where e show how thief empty him shop finish. According to am, the shop dey inside Atlantic Mall for Chevron area, and na there e dey run him jewellery business. But when e open shop, e see say thief don break enter and carry goods worth N500 million naira.
For the video wey Clinton post, e show empty shelves and counter, as e dey lament say everything wey e don ever work for don vanish. E beg Nigerians make dem help am recover the loss. As e talk: “My shop located at Atlantic Mall, Chevron was broken into and jewelries worth millions of naira was stolen.
Written by: News Editor 1
CRIME ALERT LAGOS CRIME SECURITY ISSUES
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025