Lagos

NDLEA Destroy N301bn Worth of Illegal Drugs for Lagos

todayAugust 17, 2026 3

Background
share close

Di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA), don burn over 329,865 kilograms of different illegal drugs wey dem value at more than N301 billion for street.

Di destruction happen for Navy Town, Ojo, Lagos, on Monday, following court order from Federal High Court, Lagos Judicial Division.

As im take fry mouth for di exercise, NDLEA Chairmo and CEO, Brigadier General Mohamed Buba Marwa (Rtd), say di destruction show say Nigeria serious untop di war against fake drugs

Out of all di drugs wey dem destroy, Lagos Strategic Command alone seize 246,864 kilograms between April 2025 and May 2026.

Another 83,001 kilograms come from MMIA, Tincan and Apapa Commands, Marine Command and Special Operations Unit, all for Lagos.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds